We need the best we com do election
One person choice com-be our selection
E no gud, we decided to fight corruption
Corruption wey no dey fight us
Na him sit-down dey judge us
Reverse na you be the case.

We need beta people
Na so we begin fight evil
One street one Church
Anywhere you can find a Mosque
Still, it is more of evil
Reverse you're more than a case

It is not enough
We need change
We sought for love
We arrived at lost
Why this challenge?
Why is reverse always the case?

Person wey steal maggi
dey serve for prison
Person wey thief moni
don win man of the season
Nigeria! Nigeria!! Abeg!!!
stop reverse from winning the case.

Follow me make we do a little trace
No be say I wan make case
We hustle, struggle for independence
Getam and remain dependence
62 years of borrowing cases
Abi reverse no be serious case?

E never finish....
Person wey kill person
Na him them dey worship
Save life, help another person
Your own go end in gossip
Reverse is more in our cases.