If money dey grow untop tree,
I gatz find the right seeds
Coz right now na cash-crops
Dey top of my to-do-list.
If, Money grew on trees...

Dreams without 1kobo,
Thirsty for Hennessy
But could only afford Calypso.
Once man hits the lotto
It's like turning self-con
To condo.
If, Money grew on trees...

"Hoes would always be hoes"
So, if I comot from farm
Wetin I go need dem for??

If Money, no be priority
Then CBN,
No go need security
Because robbers,
no go even Sabi Robbery...
Windows & doors
No go need any Burglary,
Compounds for no get
need for interlocking.
If, Money dey grow untop tree.

Hustlers no go need incentives.
Poor man, no go even exist
Rich men, for dey talk "humility"
Coz,
Nobody go dey dependent,
Everybody's independence.
Politics for be True-Governance
Without glitch of bias,
Reason am,
If everybody get strong finance.
"Fiancee" no go choose "Fiance"
Solely for financial "Chances"

Zero status,
Zero talk of the town,
"Osho-free" no go dey party...

What do you mean by categories??
Education for be free,
Wetin you mean by school-fees??
Students for dey study, Steady...

Pharmacists no for sell
Fake medicine..

The only thing Boys for dey Press?
Na rumpled laundry...
The only thing Gurls for dey run,
Na their race at their own pace.
If, Money grew on trees...

I for be Tarzan!
I for be Mowgli!!

Everybody for dey live in Equity...
Ki lon je; Celebrity??

Talents no for emerge
Competitively...

Skills for be free;
At every session of acquisitions...

If Money no be priority
Medicine-graduate
No go turn Banker...

Maybe some Bankers
No for turn Fraudsters.

Who 4 be Landlord?
Who 4 be Tenant??
Who 4 be debtor?
Tantrum no for possess
Any creditor...
If, Money grew on trees...

Actually, Money na plant.
Na just the seed scarce...
Some people get the seed
But,
Them no get the right soil
To plant am...
If Money dey grow untop tree,
The whole universe for be Farm.