who kon sabi finish
Who dey claim right
Who kon say him sabi
Pesin whey dey waka
Kon still dey look back
Who know how back tek be?

...
When darkness kom for night,
Plenti secret tins dey happen
Whey chikini pepu know am
Na when you join bodi with dem
Na den you go know am
Who kon wise finish?
.........

White cloth wey dem tye with black
Na who know tori wey dey di head
Butterfly wey dey envi leke-leke
Forget sey him no get cloth pass one
Mek man no tek mouth dabaru pesin own
Cox nobodi fit say how tins go leta be.

.......

Wheda good or bad,man go survive
As you dey beg mek e be for you
Na so i dey pray mek e be for me
Mek man no spoil anoda pesin own
Tabi carri pesin own join him own
Cox God wey dey judge mata still dey ervun.