Since I born
I neva see big money for my life
Dem say mah wait for my turn
say things go change be4 I becum wife
I still dey hope say E go beta.
Life don turn me upandan well well
Life don play me turn turn
As I dey i no get shi shi
I don turn looku looku
becus na to luk people weh don make am I dey do
But I still dey hope say E go beta.
When I hear wetin go give me money
I dey pursue am lik fowl see hawk weh carry im pikin
When I hear the name MONEY
I dey behav lik deer weh dey pant 4 water.
But na wetin this money tink say im be ni?
Anyhow, I know say E go beta.
If the fowl weh fly 4 air fit see food chop
when dem no get farmland
I carry dem get hope.
Dem say life no balance
but I beliv say God no go shame me
Na same God create us
I know say dat God weh dey give them food
go give me too.
I beliv say 1day E go beta.
E Go Beta
Edith Nornubari
(C) All Rights Reserved. Poem Submitted on 05/02/2026
Poet's note: This is me assuring myself that everything is gonna be okay.
(1)
Poem topics: change, people, water, wife, wait, play, create, shame, food, hear, god, hope, life, money, Print This Poem , Rhyme Scheme
About E Go Beta
E Go Beta is a poem by Edith Nornubari. This page includes the poem text, poet information, related topics, comments, and similar poems.
Write your comment about E Go Beta poem by Edith Nornubari
Best Poems of Edith Nornubari